Story::: Adanna...Episode 1



Enjoying my sleep in the evening around 8pm on
saturday, na 10pm i dey take sleep before but since no
food to chop i gat to sleep and put the groaning worm in
my stomach at rest, i havent slept 30 minutes wen my
phone rang, i check the caller na blessing.
Me: baby whatsup
blessing: i don tell you make you nor dey call me baby
again, where you dey?
me: i dey my house na where you expect make i dey
before?
blessing: your girlfriend house na.
Me: i don tell you na only you be the girl wey i get.
Blessing: na who be your girl, let my guy catch you, your
own don finish be that, abeg i don buy that laptop come
help me check am weda na better one and to configure
am for me abeg.
Me: abeg make am tommorow i dey tire and i wan sleep.
Blessing: abeg na i nor fit watch film for inside self and i
need to keep myself busy.
Me: call your boyfriend na
blessing: i don tell you my guy no dey leave here.
Me: na who come dey sample u na?
Blessing: sample what?
Me: sorry nothing.
Blessing: e better be nothing rotten mind, by the way i
cook rice.
Me: am on my way.
Blessing na my coursemate for one polytechnic wey dey
MCC aba, i don try chike the babe many times, but the
babe dey form strong head for me, but since she want
something from me then i must get something in return
apart from the rice, we must balance the equation,
afterall one great man say, “For every action, there is an
equal and opposite reaction”. There must be an opposite
reaction today oh.
ingredient nor dey dey her food but the food dey sweet
well, she is dark in complexion not too tall, her behind
not too big and not too small, her breast is average also,
as for me am fair, hairy and tall.
I put on my clothes and took my phone and my earpiece
why i head to her place, her house far small sha but i gat
no choice, i must consume that rice oh, i check the time
8:45pm, everywhere is dark nobody dey road, e be say
people quick enter house today oh, maybe na the wether
cause sha,
i was walking slowly enjoying the music booming from
my earphone like tecno Boom J7 when someone flash
light from behind, i removed the earpiece i heard a lady
voice from my back calling my name “ozilla” i turn back i
saw nobody, na who come call my name na, e be like
say the hungry don dey make me hear different things, i
pocket my phone and continue moving i fasten my
footstep, half way to her place i heard the voice again, a
slick tender voice from my back, “why are you moving
fast” i look back again i saw nobody, oboy na which kind
thing be this na, i run oh because this time i heard it
clearly, i ran as fast as i can till i get to blessing house. i
didnt hear her till i reach her house, she live in a fence
house but no gate, her room was build separately beside
the main building just like a store, one room.
I knock on her door, she didnt answer, i knock again and
i heard ” who is that”
Me: idiot na me open the door.
She open the door and i enter and i quickly closed the
door.
Blessing: wetin happen why u dey sweat like hegoat.
Me: u nor go understand.
Me: abeg give me water first, before i quench.
Blessing: tell me wetin happen wey you dey sweat like
this, na dog pursue you?
No be only dog, this one worse pass dog, e for better if
na dog, but dog no dey talk na, she gave me water, i look
around no sign of any cooked food.
Me: wey the food wey you say you cook?
Blessing: abeg no vex i know say u nor go come thats
why i use the food draw you.
Me: please tell me you are joking.
Blessing: am not and am sorry.
Me: you mean say all this suffer wey i don suffer for road
all na for nothing,
Blessing: no vex na abeg i just want you to help me with
my laptop.
Chai awish no be girl i swear i for slap her, I was very
angry, i stood up, go to the door and wanted to leave,
she stood up quickly and block the door.
Me: let me dey go abeg.
Blessing: why you dey quick vex like this na.
Me: if you know the kind thing wey happen for road you
nor go talk like this.
Blessing: na wetin go happen wey you go come leave
without eveing seeing the laptop.
Me: that one no concern me again, i need something to
quench the worm disturbing my stomach.
I wanted to move her away from the door so that i will
pass, she hold the hand and put it on her chicks, looking
at me in a seductive way, i rub her chick with my hand
while she bite her lips in a seductively, she wore red
legins with a handless shirt, she put her two hands
around my neck, draw my head closer and gave me a
sweet kisss, waoh i was flabbergasted, girl wey i don dey
try to chike since come dey give me free kiss, omo i gat
to grab the opportunity.
I return the kiss and press her against the door, i press
her breast and she moan a little, i removed her shirt and
move her bra one side and kiss her sweet breast, she
moan again, i lose her bra and bury my face in her breast
as she use her right leg to draw my body closer to her.
.
.
Tbc
Previous Post Next Post

PROMOTE YOUR TRACKS WITH US TODAY(CLICK HERE)