Story::: Adanna...Episode 5




Waoh i dial the number
” the number you are trying to call is currently switch off,
please try again later” i hate that woman, the time is
8am on monday and i have test around 9 in the morning,
but i dont think the test is important now, adanna is more
important for now, so i stood up, brush my teeth, worm
my afam soup and took my bath, i ate the afam soup and
eba silently, (i like that soup well well) thinking about
adanna.
Number she use to call me just now how can it be switch
off, i redial again, but still switch off i droped the phone,
as i ate silently a test enter my phone again, i thought it
was adanna, i quickly rush to read it,
“fuckiing me is one thing and fuccking my friend is
another thing, becareful we are watching you”.
Frm chinansa.
Lol abeg make she go sit down joor, i nor get her time
and she cant do more than a dead rat, wey she and her
sister dey fight for one man, maybe she think say i nor
know, another call enter my phone from mercy.
Me: hello sweetie
mercy: hey dear, i hope you are in school already,
because am almost at the gate.
Me: no oh, am still at home.
Mercy: still at home by this time, or you forgot that we
have to revise before the test.
Me: yeah i remember, just give me 30minutes i will be
there.
Mercy: ok i will be in room 101 please be fast.
Me: ok dear see ya.
I told her i will be there before 30minutes, but am i really
going? Hmmm question for the gods,
.
I finish eating, took my bath, then lie on my bed, wearing
just my boxer and singlet, a call enter my phone again,
this time unknown caller, i pick it.
Me: hello
unknown caller: it seems you are not going to school.
Me: adanna.?
Adanna: yes.
Me: waoh, your voice sound so sweet.
Adanna: hmmm are you sure.
Me: yes of course infact everything about you is sweet,
your voice, your, lips, your breast, and even your….
Adanna: e don do, by the way, am sorry for leaving like
that i just dont want to disturb you.
Me: no problem, but what happen to the bulb?
Mercy: which bulb?
Me: the bulb that shattered when we were having sex.
Adanna: i think you need to go take panadol, because
you sound weird.
.
Hmmm, maybe i was seeing things sha, i check my time,
8:40.
Me: ok i have to go now, i will call you later when i come
back.
Adanna: you are not going anywhere, because there will
be no test.
Me: how? What do you mean, hello, hello, hellllooo.
Well maybe her credit don finish, i tried to call her, but
her number switch off, na waoh, i got dress, spray my
aboki perfume, comb my hair and set for school, as i was
about to open the door, my phone rang, caller mercy.
Me: i don dey road already i will be there soon.
Mercy: no need am coming to your house.
Me: why, what happen.
Mercy: our lecturer call in sick.
I went out to buy hollandio yoghurt and bread at one
supermarket close to calabar kitchen (if u know aba well
you go know that area) at MCC road there, i came back
remove my clothes and lie down, i open my hollandio
drink and start drinking, i tried to watch movie from my
laptop but i nor fit, i just cucuma relax for bed dey reason
adanna matter, i dont know if i should tell mercy because
she worst pass prayer warrior, i remember the time wey
she dey scatter prayer for her compound, the landlord go
knock for her door telling her shes disturbing the
compound, na so mercy open mouth tell am say, im nor
fit stop am from praying to her God, the landlord vex
slap her twice, chai that thing vex me well, that night
mercy cry come my house, the next morning i carry
police go arrest the landlord and the yeye police carry 5k
for my hand before them gree go arrest am, well the man
pay 10k later for hospital bill even though i nor carry her
go hospital.
Though i know say na mercy dey at fault, because there
is one verse in the bible that say, dont disturb others
when praying, i nor remember as them quote the verse
sha.
I was lost in my thought when someone open my door.
Mercy: sweetheart how you dey?
Me: i don tell you make you dey knock if you come my
house.
She went back and knock and i said come in.
Mercy: are you happy now
me: yeah,
mercy: so how are you
Me: am fine and you?
Mercy: am alright, this one wey you just relax so as if
person die i hope everything is alright.
Me: am just thinking about you dear.
Mercy: what are thinking about.
Me: about your beauty, after God don create everybody
finish, God come rest for more 7 days before im create
you, na im make you fine like this na.
Mercy: abeg spare me your sweet sweet mouth, wetin
dey pot?(she said and took my hollandio, she sip it)
Me: no be wetin you cook last.
Mercy: why your room scatter like this na.
Me: i nor know oh, i dey tire i for arrange.
Mercy: before i met you, your room is always neat and
clean, but now you are always too lazy to clean your
room.
Me: na im make God send you to me na.
After she finish my yoghurt and my bread as if i bought it
for her, she took my dirty plates outside and wash all of
them, she told me to go outside that she want to clean
the room.
Me: make i even stroll go outside self,
mercy: stroll go where.
Me: make i reach viewing center (even if match no dey
today)
mercy: buy sunshine when coming back.
me: no wahala.
I took 500 naira from my wallet, i went out, on my way i
saw my loving neighbour chinansa outside washing
clothes, she just eye me then hiss like snake, when i first
come to aba, na she be my first lover, but she come dey
claim activity, like if any girl come my house she go dey
question like frank edoho, the thing come dey dey too
much so i started shunning her, she no even fine self but
she get big ass like toolzs.
I went out to mcc junction, i cross the road and enter one
bear parlour, they call it china town, i went in and order
for smirnoff, i was drinking my drink gentlemanly when i
saw her coming down from toyota avalon with one big
man with pot belle, waoh na blessing be this, oboy i
clean my eye well well, i nor mistake na she, the man old
enough to be her father put hand on her shoulder, they
came inside the bar, she saw me i wave, she just bone
me like one madman, i nor blame her, later she go dey
form virgin for school,.
They look for sit and sat down, the man call for barman,
the barman later came back and serve them two guider,
waoh so she dey drink self.
I continue watching them till test enter my phone.
“you go watch tire today till you blind”
.
.
Tbc
Previous Post Next Post

PROMOTE YOUR TRACKS WITH US TODAY(CLICK HERE)