Story::: Adanna...Episode 12



I just read the message and smile, if the she no succeed
for the first time wetin make her think say she go
succeed this time, abeg make she go sit down joor, she
even get boyfriend na im she dey sanko my dicck join
abi, na thunder go fire that her big yashh, i took my
darling laptop, i check my cassete and i select “arrow 3” i
like that film die, the guy join act for the flash self.
I concentrated on my film, sleeping on my bed and
backing my door, my stomach rumble, na wetin i go eat
na, i thought assuming mercy dey here na she go just
cook for me sharp sharp, hmmm i think am missing her
already, then i remember faith, i gave her money to buy
obstacle for her soup, i quickly stood up, took my cooler
and put it on black bag, i lock my door and set out to
faith house, on my way i saw chinansa discussing with
three grab guys i went to meet her.
Me: good evening chinansa, bros una good evening oh.
Chinansa: what, can we help you? She said eyeing me
from head to toe.
Me: una dey plan how to attack me abi? No wahala,
thank God say i still save your number for my phone and
as e dey like this na im i dey carry am go show police
(for my mind, lol who wan waste 5k again) so, because i
dey my own jejeje you carry wahala come my
doormouth, abi na by force to date you, no worry police
go come your house tomorow morning,
she just kept looking at me like a boyscout.
Me: as for una, i don mark una face if anything happen to
me, na police case una go find una self .
Bro 1: oga mi why you dey para like that na, you na our
man na, and na we we, so make you chil like ice water
( he said opening his open teeth like solomon randy ;D.
Bro 3: na we we make you nor dey para again u dey feel
me so, as we don see u so, we don believe say u na
correct guy, so chinansa my hand no dey again i dont
commot ( he said washing his hand like pilas, no be say
water dey oh) .
They walk off chinansa, and disappear, then she face.
Chinansa: you think say i dey fear police, if you like go
carry soldier, mopol, and even carry mobile police join
(mumu mopol no be mobile police) infact go carry boko
haram join, all i know is that i must revenge my boyfriend
i dont care how i go about it, she said and catwalk out of
me, omen see her yash as she dey waka, na that yash
first make me go meet her, now that yash wan put me
for am again, i clear my head and set to faith house.
I walk to the main road (mcc) and corner to umuojima
road after 5minutes of walking, i turn over to her street
and 2minutes later i found myself at her doormouth.
Kokoko i knock, who is that? She answered.
Me: memeor oziegbe, hwiode ah ( na me open door)
faith: se muza iva de ( wait am coming).
She opened the door, and i saw her sweating like
shegoat, i enter inside and saw another man sweating
like hegoat chai my edo sister oh, i smiled.
Me: good evening sir.
Bros: good evening oga how we dey.
Me: you dey fine sir, but me dey hungry.
Faith: u nor well i know say na im make you come, see
the pot for there carry am as you want.
Why she no go talk like that wey she want make i leave
sharp sharp so that they go continue their kerewa ontop
bed, lol, if na before she nor go even gree make i touch
spoon talkless of to carry soup for pot, i jejely pack the
soup and remain small one for her ( black soup na one
of my best soup so i nor dey use am play ) after i finish
tie the nylon i told her bye and leave her and her loving
loving make them continue were them stop, i walk out of
the compound, i enter umuojima road and after 3minutes
of walking i heard something from my back following me,
i look back i didnt see anybody, i continue moving, then i
heard the footstep again, i look back and i saw nothing, i
dial adanna number and i heard the ringtone from where i
was standing, i look back where the sound was coming
from i didnt see her, then i turn to face front and woai
she stood in my front like undertaker almost taking my
breath away making me to drop the cooler ( chai ) that
soup pain me die, she saw the dissapointment in my face
and said. “dont worry i will pay for it by taking you out,
from there you can ask me any question you want”
my belle sweet me and the worms in my stomach make
noise in form of celebration.
Adanna: why are you starring at me like that and smiling.
Me: the way you say you will take me out make me want
to kiss your lips.
Adanna: and what are you waiting for?
Me: because we dey road and somebody might……
Come here joor she said planting a wet kiss in my
mouth, she wore white gown, with red trouser like indian
woman, she wore red shoe and yes that bangles still dey
hand,
after drawing the breath out of me through kissing, she
hold my hand and we continue walking.
Me: so what are you.
Adanna: a little patient now wont hurt, huh.
Me: why must we get to were we are going before we
start discusion.
Adanna: because we are not alone and i wont want to
share my secret to everybody.
Me: okay if you say so no problem.
Adanna: thats my love, she said showing me her rice
teeth.
Me: so is there no way you can just make us vanish to
were we are going.
Adanna: ahahahahahahaha
Oh God i love her laugh.
Adanna: and what makes you think i can do that.
Me: because you have been doing it, like how you
dissappear to slap blessing and how you always come to
my aid mysteriously.
Adanna: ahahahaha i dont do that, i only watch you in a
mirrow.
Me: waoh so you mean you slap her through mirrow.
Adanna: yes, ok thats enough, when we get to were we
are going you will get more answers.
Me: ok where are we going by the way?
Adanna: when we reach there you will know.
We continue walking discussing about school till we get
to anyankwo market we enter the street beside it, and
continue walking till a place i know nothing of.
I check my time on my phone 8:46pm, no network on my
airtel and on my mtn sim, we walk for 20minutes more i
check my time again it say 8:46 again, still same time
and no network, then fear begin catch me.
.
.
.
Tbc
Previous Post Next Post

PROMOTE YOUR TRACKS WITH US TODAY(CLICK HERE)