I was on my way home, when i branch at one
supermarket i ask how much for catton of indomie they
said two thousand four hundred naira, i went home and
check my wallet, money no dey, na which kind wahala
be this na eh, i put a call to my loving elder sister.
Sister B: hello
me: good evening ma
sis B: how you dey
me: i dey manage
sis B: na manage you dey always dey manage, you nor
dey satisfy
me: hahaha when i finish school then i go satisfy.
Sis B: so wetin you want this time.
Me: na just small change.
Sis B: wetin una wan use am do.
Me: we dey go for excursion and e dey compulsory for
everybody because if we nor go, we nor go fit report am.
Sis B: yes na true, na im make you be science student,
na how much
me: na only eight thousand naira
sis B: okay tomorow na sunday i go send am for you on
monday.
Me: thats my loving sis.
Sis B: only when money is involve abi?
Me: haa no oh, you nor say na you be my second
mother.
Sis B: na u sabi, i hope those girls no dey disturb you for
there sha.
Me: no i still be virgin na, or you nor trust me again?
Sis B: why not, you better remain virgin because after
school na me go find woman marry for you.
Me: and i hope you don dey find down.
Sis B: no oh i dey wait make you finish first.
Me: okay no problem i hope the girl go fine like
genevieve.
Sis B: no be about fine na about character, i think say i
don tell you before, the beauty of a woman is inside not
outside she said.
Me: okay i don hear bye bye make i do assignment.
I cut the call, truly no be about fine sha, if say na by
beauty lara for nor gree marry oshiomhole na, but na
because of money lara marry oshiomhole, so any one
wey she find for me, if e nor fine she must get pepper.
I took my wallet and head to first band opposite MCC
road there, i reach there omo see que, the que long reach
road sotey them come bend like snake, upon all say na 6
atm matchine dey there oh ( i hear say them don do
three join), i waited for my turn, while waiting i receive a
call from adanna.
Me; hello hurney
adanna: how are you durley
me: am fine.
Adanna: were are you that place look noisy.
Me: yeah am at first bank, trying to withdraw some
money.
Adanna: what do you need money for?
Me: just to buy catton of indomie
adanna: i see no problem, please go home when you
finish in bank, when i come visit you we will go and buy
the indomie together.
Me: yes my love.
Adanna: alright see you then bye.
Me: alright take care.
I withdraw 2k remaining 1k for my account, i went home
direct, to wait for adanna, when i get home, i saw the
padlock of my door open, i open the door and went in
and there lay the charming angel with two catton of
indomie on the floor.
I open my door and the mysterious lady was sitting on
my bed mysteriously with two mysterious catton of
indomie on the floor, she wore a short skirt abi mini skirt,
and a white handless shirt, i walk in majestically like a
gentleman.
Adanna: hello durling (she said standing up to meet me)
how are you.
me: am alright, i dont need to ask you how you got my
key, but why didnt you tell me you bought the indomie
already (at least i for no go withdraw that small change
wey dey for pocket na)
Adanna: well i wanted to surprise you. (she said, giving
me a peculiar kiss)
Me: and you did a hell of a job, thanks alot dear ( i said
settling down on the bed with her)
Adanna: o come on you dont need to thank me, if i dont
take care of you who will? (according to ritababe).
Me: thats why am the luckiest man in the world and am
lucky to have you.
She smiled as we sat down together on my bed, no light
for house chai gbege ( and the one wey she dress come
like this something must happen oh, and my room wey
dey hot like hellfire when no light, she brought hollandio
yoghurt from her bag and bread, we started eating and
discussing.
Me: i thought you dont eat those type of foor.
Adanna: and what do you think i eat?
Me: well maybe human blood or flessh
she laugh out loud, oh god i so much love seeing her
laugh with her sparking teeth like diamond
Adanna: well you are right but am not some kind of
vampire or cannibal, but those food am eating mean
nothing to me, i just consume them to balance your
satisfaction, my real food is live meat.
Me: live human? (getting scared as if if she want eat me
she for never eat me since)
Adanna: yeah i mean like live rat, frog and others.
Me: others like wat
Adanna: like human.
I was putting food in my mouth when she mention
human i paused like somebody wey im mama catch dey
thief meat for pot like cherrybrown ;D
Adanna: come on i was just pulling your leg, i dont eat
human, if i do those guys that attack you that, that body
would not have been found.
Me: what you did was hilarious ( i said calming down).
Adanna: yeah i know and i dont regret it, something
would have happen to you if i didnt stop them.
Me: but chinansa is wicked oh, by the way its been long
since i saw her, i think she travel.
Adanna: yeah, she travel and you will never see her
again, she said bowing her head in a sorrowful way.
.
.
Tbc


Post a Comment