I sit down for inside house i don finish one plate of rice
na the
second one i they now, heavy rain they fall for outside
and the time
say six thiry in the evening, Blessing stay ground they
watch movie
since nothing to do na so fan they blow and light they
shine for up,
sometimes i nor they understand Nepa oh when rain they
fall no be e
them suppose take light? But na now light they scatter
for ground well
na them sabi sha na them know how them they run their
thing.
Me: Ble how far.
Ble: i they oh you don finish am?
Me: yes oh abeg you fit bring come again.
Ble: Jesus Christ na tank they your belle?
Me: no be my fault na the food sweet na.
Ble: me i never chop oh food don finish for pot.
Me: abeg na you go cook another one na.
Ble: just carry the pot for there and pack stew put.
Me: thanks love.
I go where she put the pot and took it i annex stew put
and went back
to my sit and sat down consuming the food like say no
tomorrow, i dont
really know whats wrong with me anytime i see food wey
sweet i nor
they think of tomorrow i just want finish that food that
day.
I finish everything on the pot you wont blame me now
would you? after
all i never eat afternoon food so na afternoon own and
evening own i
eat so, na only night food remain (i believe 80 percent of
nigeria
student eat night food).
After consuming everything i kept the pot for her, i look
outside and
see say the rain don they stop small small i went inside
and sat down
again looking at her big ass like that of Mercy Johnson,
her own nor
too big like Mercy Johnson own sha Mercy Johnson
own na Elephantiasis.
I join her on the floor and we watch movie together, shes
watching one
old America film titled Tarzan, wey Jane go they call
Tarzan e go be
like say she they call cowbell (na her tongue sha).
We watch movie till 7, 8, 9 before rain gree stop i wanted
to sleep
but i know Blessing wont agree so the best thing na to
enter this
kpotokpoto road they go house, she escort me reach her
street road
before she turn back, everywhere don dark as if na
twelve midnight we
they though light they shine for everywhere but i still they
fear as i
come out for Blessing street i meet two road, the one on
my left lead
to my school and kpotokpoto go they road well well, the
one on my
right lead to main road thats MCC road, so i decided to
follow that
road because light they road and the road them tile the
road also, na
there Adanna first for meet me when i they go come
Blessing house now
i they commot for Blessing house and i hope and pray no
more Adanna,
any Adanna in my life i rebuke in Jesus name Amen. (did
i hear you say
Amen)
I was walking silently to the main road i cant walk fast
because i
will fall i use my infinix phone as torch i walk for two
minutes
before i reach MCC road, as i reach there i turn left they
go the
junction na before the junction you go meet my house
because the road
they tiled i begin waka fast though kpotokpoto still they
enter my leg
and rain still they shower small small, na to reach house
and enter
bathroom sharp sharp.
I was walking fast till i get to burkingham college
everywhere they
quiet and no sound anywhere apart from that of owl and
the raindrop,
as i was going to my house at my front i saw people
coming towards me,
though them they far i never near them at all them be
like five to six
guys like that them hold something for hand, i nor know
wetin e be i
wasnt afraid because na guys like me, though that
boldness disappear
when i saw that the thing they hold on their hand is gun,
when i see
it i first pause then i jejely they waka go back small
small, them
they waka fast come meet me omo i gat to run oh e be
like say na me
them come for, i ran inside between two building and i
hear them say
“stop there” thank God say i know this area well well, i
enter one
corner for there and burst out for one big compound wey
i fit follow
go umuojima road i begin they go Omuojima road where
that big erosion
they, i think say i sabi road i nor know say i be ju as i
they comeout
from the third building i saw another guy with heavy gun
standing on
my front backing me, i quickly turn back but as i don
pass the third
building they go back i they hear the footstep of the guys
wey they
follow me they come, omo i dont know what to do oh, i
they between one
big building and one small one like student building
though before
them fit see me them need to search five houses wey
they that area
and e no they possible, so i decided to hide in the back of
the second
house, as i they waka they go somebody for the first
house open door.
“come inside” I was shock like hell because i dont know
the person.
Unknown: if you want to live come inside now.
I dont really think i have a choice oh i have to take the
risk so i
follow the unknown to the room, i enter the room and the
room they
very nice, she on her rechargeable light and yes i
remember her face
the new girl. (Beginning Of the Story)
.
.
Tbc


Post a Comment